Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Romans 14:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 God word sey, “Weda dem like am or not, evribody go knee down for my front kon sey na mi bi God.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Romans 14:11
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

All di kings go bow for am and all di nashons go serve am.


Make una look round kon si wetin dey happen! Make all una sons gada kom meet una! Naw God dey sey, as long as una shidren dey alive, dem go bi like pomade for una body; una go wear dem like di gown wey woman wey won marry dey wear.


God sey, “As far as I bi di God wey dey alive, Jehoiakim pikin, Jekonaya wey bi king for Judah, yu nor go fit bi king for dis eart. I go take dat pawa komot from yor hand.


“So as long as mi God dey alive and as una don spoil my temple with una juju and all di bad tins wey una dey do, I nor go sorry for una wen I dey distroy una.


Naw, God wey dey lead Heaven Sojas sey, “As long as I dey alive, I go distroy Moab and Ammon pipol finish, just as I distroy Sodom and Gomorrah. Na shuku-shuku go full dia land; I go turn am to salt pit and skata am forever. My pipol wey remain, go take evritin wey remain for di land.”


Make una tell dem sey, ‘As long as I dey, I go do anytin wey yu sey make I do. Na mi wey bi God tok am.


“Anybody wey tok for publik sey en know mi, na so mi too go tok about am give my Papa for heaven.


But if yu konfess with yor mout sey, “Jesus Christ na Oga God and yu bilive for yor heart sey, God raiz am from grave, yu go dey save.”


so dat Gentile pipol go praiz God sey e dey good to dem. Just as God word sey, “I go tell Gentile pipol about yu and I go sing, dey praiz yor name.”


If anybody sey Jesus na God Pikin, dat show sey, God dey inside am and e dey inside God too.


Bikos pipol wey dey deceive odas, don enter di world; dem nor gri sey Jesus Christ don kom dis world as human being before. Dis kind pipol dey deceive odas and na anti-Christ dem bi!


And di for creatures kon sey, “Amen!” Den di eldas fall face groun kon start to woship God.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ