8 Make love bi di only tin wey yu dey whole! If yu love odas, yu don do evritin wey di law tok.
Bikos of dis, make yu trit pipol as yu wont make dem trit yu, bikos na so dem rite am for di Profets and Moses Law.
“I dey give una new kommand: Una must love each oda, as I love una,
If yu love pesin, yu nor go do am bad. So, na love bi di main tin wey di law dey tok about.
Make una pay evritin wey una dey whole; weda na tax, respet or honor.
Bikos if dem add di whole law togeda, dem go kon bi one kommandment wey sey, “Make yu love yor neighbour as yu love yorsef.”
With all dis good tins, make una love one anoda, bikos na love bi di best tin wey fit whole una togeda.
But di rizin why I dey give dis kommand, na bikos I love dem from my heart with betta mind and faith.
But if una do wetin dem rite for God word, “Make yu love yor neighbour as yu love yorsef,” una don do good bi dat.
Na like dis una go take know God and devil shidren. Pesin wey nor dey do wetin good for God eye and nor love en broda or sista for Christ, nor bi God pikin.