Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Romans 13:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 Bikos all rulers na God savant and na dia duty to help una. If una do bad, den make una fear, bikos dis rulers get pawa to ponish una. Dem bi God savants wey dey ponish doz wey do bad tins.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Romans 13:4
23 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Make wi praiz di Oga wey bi yor God! E don show how E dey happy with yu, bikos E make yu king for Israel and di love wey E get for Israel pipol, go last forever. E don make yu dia king, so dat yu go fit keep di law and dey judge well.”


King Jehoshafat tell di judge dem, “Make una dey kareful for wetin una dey do, bikos una nor dey judge for men, but na for God wey go dey with una wen una dey make decision.


Wise pesin go try make belle dey always sweet di king, bikos if di king vex, somebody fit die put.


Wen king vex, e bi like lion wey dey shaut; to make am vex, mean sey yu won kill yorsef.


Wise king dey skata wiked pipol like flower kon ride horse on-top dem.


Wen king sidan for en throne dey judge, e dey fit know bad tin wen e si am.


Make una learn to do good; make una make sure sey una dey judge well; make una help doz wey dem dey opress. Pipol wey nor get papa and mama, make una give dem wetin dem wont and make una help wimen wey dia husband don die.”


Dem don fat and dey chop betta food. Dem nor know wen to stop all di bad tins wey dem dey do. Dem nor dey give doz wey nor get papa dia rite or give betta judgement to doz wey dem dey opress.


Pipol wey dey rule bi like wolf wey tear animal into too. Dem dey kill pipol, so dat dem go get money.


My pipol Israel go revensh Edom and dem go let Edom pipol feel how my vexnashon strong rish. Den Edom pipol go know wetin e mean to take revensh.” God wey get pawa don tok.


Una wey bi leaders for Israel, make una listin to mi! Una hate to judge well and dey shange evritin wey dey rite.


Make una nor try to pay anybody for di bad tin wey dem do una, but make una leave am for God, bikos God word sey, “Na mi go revensh for una. I go pay dem back.”


Una must still pay una tax too. Di rulers na God savants and na dia work to kare for all dis matter.


Make nobody shit en Christian broda or make am vex, bikos na God go fight for di pesin wey yu shit and wi don tell una before and wi still dey warn una sey, God go really ponish pipol wey dey do like dat.


Wen di pesin wey won take revensh find am kom, dem nor go let am attack di man, bikos na mistake e take kill di pesin.


Dis na di towns wey dem give all Israel pipol and doz wey dey stay with dem. Wen pesin kill anoda pesin by mistake, e fit run go der and who won kill-am nor go fit kill-am again, until di eldas judge en kase.


or govnors wey God choose sey, make dem ponish pipol wey do bad and praiz doz wey do good.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ