14 Instead, make una wear Jesus Christ like klot for body. Den wi nor go do di tins wey awa body wont.
I dey always do betta tin. Evritin wey I do dey always dey good.
Una wey dem don baptize inside Christ, don wear Christ for body like klot.
Pipol wey dey inside Christ don kill dia flesh with all di bad tins wey di flesh dey like to do.
Den, true raitiousness and holiness wey di trut dey bring, make una wear di new man wey God don kreate like ensef.
E bi like sey dis tins get wisdom, bikos pipol dey woship angels; dey pritend sey dem good and dey sofa dia body, but dis wisdom nor get value, bikos e nor fit stop pesin make e nor do di yeye tins wey dey en mind.
My friends, I dey beg una, since una bi strenjas for dis world, make una nor follow di tins wey pipol like to do, bikos dem dey distroy pesin soul.