Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Romans 12:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 True God grace, E don give us difren-difren gift to use. If wi dey profesai, make wi do am akordin to di faith wey wi get.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Romans 12:6
31 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

I go send profets, wise pipol and law tishas kom meet una and una go kill and nail some for cross, flog some inside una sinagog, den porshu di odas from one town go anoda.


“Di one wey dem give two koins still sey, ‘Oga God yu give mi two koins. Si, I don get two koins join dem.’


Na dis one make God tok with en wisdom sey, ‘I go send profets and apostles go meet dem and dem go sofa and kill some among dem.’


Dis na di profets and tishas wey dey di church for Antiok: Banabas, Simeon wey dem dey koll Naija, Lucius wey kom from Sirene, Manaen (wey bi Herod di Tetrak friend from small pikin) and Saul.


But Judas and Silas, wey bi profet, enkourage di pipol and wetin dem tok kon make di pipol heart strong.


“ ‘Wen di last day don rish, God sey, “I go pour my Spirit inside evribody and all una shidren, both boys and girls go dey profesai, una yong men go dey si vishon and una old men go dey dream plenty dreams.


(E get for dotas wey neva marry, wey dey profesai.)


Bikos I dey hongry to si una, so dat I go give una di Holy Spirit blessing wey go make una strong,


By di grace wey God give mi, I dey tell all of una, make una nor tink sey una too dey important. Instead, make una use good sense tink and undastand di faith wey God give una.


But God don put evry part for awa body, just as E wont am.


if I dey profesai and fit undastand evry sekret and knowledge or if I get faith wey fit move mountins and I nor love oda pipol, I go bi nor-tin.


Na love suppose guide una. So make una dey fight to get di gift wey di Holy Spirit dey give, especially di gift to profesai.


But if evribody dey profesai and unbilivers or pipol wi nor undastand enter di church, dem go know sey dem bi sinnas and dem go won turn from dia sin kom meet God, bikos of wetin una dey tok.


Two or three pesin fit profesai and evry oda pesin must listin well-well.


Mi and Apollos na God savant and E use us take prish to una make una for fit bilive, so mi and am dey do di work wey God sey make wi do.


How I wish sey all of una bi like mi. But di gift wey God give us nor bi di same.


Bikos if e really dey una mind to do am, anytin wey una give akordin to wetin una get, God go asept am, but nor bi wetin una nor get.


Di pipol wey dey before nor know dis sekret as God don show en holy apostles and profets wey dey naw, thru di Holy Spirit.


Na Christ make some among us bi apostles, profets, evangelist, pastors and tishas.


So wi wey don mature for Christ, make wi get dis kind mind. But if una dey tink difren tins, I bilive sey God go show una di trut.


Make una nor take God word wey pesin tok as yeye tin.


Di one wey important pass bi sey, una know dis tins: e nor get anytin wey di profets tok for God word wey just kom out from dia own mind,


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ