Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Romans 12:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 Make una give food to God pipol wey dey hongry and make una dey welkom dem for una house.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Romans 12:13
30 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Dem know sey David and en men go dey hongry and wota don dey hongry dem since for di wildaness.


so make wi make one small room for up kon put bed, tabol, chair and lantan for der, so dat wen ever e kom, e go stay here with us.”


Na blessing go follow doz wey dey do good for poor pipol! God dey always save dem from trobol.


E dey always give tins to poor pipol and to doz wey know get at-all.


Wen I dey hongry, una give mi food, wen I dey thirsty, una give mi sometin drink and wen I bi strenja, una let mi enter una house.


Fear katch am as e dey look di angel, so e ansa, “Oga God, Wetin yu wont?” Di angel tell am, “God don hear yor prayer and si all di good tins wey yu dey do for poor pipol.


kon give di apostles make dem keep am, so dat dem go gi-am to anybody to take buy wetin e wont.


If wi dey prish, make wi prish well. If wi dey give, make wi do am with betta mind. If wi dey lead odas, make wi do awa best. If wi dey do good to odas, make wi do am with happiness.


Una know sey na Stefanas and en family first bilive God for Akaia. Dem don do evritin wey dem fit do for God pipol. My friends, I wont make una


I nor nid to rite to una about how to help God pipol wey dey Jerusalem,


Bikos dis work wey una dey do so, nor just dey help only God pipol, but e dey always make pipol, tank God.


So anytime wey wi get shance, make wi dey do good, especially to pipol wey bi God shidren.


Leader for church must bi pesin wey nor get fault; wey get only one wife; fit kontrol ensef; get sense and respet; dey welkom pipol and e bi good tisha.


Evribody go know am for di good work wey e dey do sey: e don train shidren; dey welkom strenjas; dey serve God pipol; dey help doz wey nor get and e dey do difren good work.


Instead make e dey welkom strenjas for en house; love wetin dey good and e must get sense; make e nor dey put hand for bad tin; e must dey holy and fit kontrol ensef.


Like dis too, awa pipol go learn how to do good and help pipol wey really nid help. And as dem dey do like dis, dem nor go live yuzles life.


I get joy and my heart dey strong bikos of yor love and thru yu, all God pipol heart don strong too.


Make una nor forget to do good and to share wetin una get with each oda, bikos doz kind sakrifice, dey make belle sweet God.


Make una always dey welkom strenja for una house, bikos like dis, some pipol don welkom angel enter dia house and dem nor know.


God nor dey support pipol anyhow. E go remember how una help en pipol before-before and how una still dey help dem naw. Una bi God pipol and E nor go forget di love wey una show en shidren.


Make una welkom pipol for una house without komplain.


But pesin wey get enough tins and e nor sorry for en broda or sista for Christ wey nor get at-all, na how God love go take dey inside am?


My friend, di tins wey yu dey do for awa brodas wey yu nor even know, good well-well.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ