E ansa, “My Oga God wey get pawa, na only Yu I dey serve, but Israel pipol don break di kovenant wey dem make with Yu. Dem skata yor altar kon kill all yor profets. Na only mi remain and dem won kill mi too!”
Dem build altar for Baal juju, so dat dem go fit sakrifice dia shidren gi-am. I nor sey make dem do like dis and I neva even tink about dis kind tin at-all.
Before-before, wen Efraim pipol dey tok, di oda tribes for Israel dey fear and respet dem. But naw, Efraim pipol dey woship Baal juju and dis tin kon distroy dem.
Na with my hand I go take skata Judah, Jerusalem and evritin wey koncern di Baal juju wey dem dey woship. I go distroy all dia wiked priests and nobody go remember dem again,