32 God trit evribody as prisonas, bikos wi nor gri do wetin E tell us. But E do am like dat, so dat E go fit sorry for all of us.
E kom bear witness for di lite, make evribody for fit get di shance to bilive wetin God tok thru en word.
But as for mi, if una karry mi go up for cross, I go draw evribody kom meet mi.”
Bikos God don sorry for una, E go still sorry for dem too.
Na di faith wey pesin get for Jesus Christ go make am dey good for God eye. Anybody wey bilive Jesus, God dey make en faith strong, weda e bi Jew or Gentile pesin.
So wetin wi go tok? Wi go sey na wi wey bi Jew betta pass? Dat na lie! Bikos as I don already show una, Jew and Gentile pipol dey kommit sin.
Bikos Adam nor obey God, many pipol bigin sin. But since Jesus obey God, many pipol go obey God too.
But God word kondemn evritin and evribody under sin, so dat wi; di pipol wey bilive, go get God promise thru Jesus Christ.
Before faith kom, wi dey under di law, bikos di law whole us like prisonas.