I dey ask una again, “Israel pipol nor undastand?” Moses first tok sey, “I go use pipol wey nor bi anytin, so dat una go dey jealous dem. Na pipol wey nor get sense, na dem I go use take make una vex.”
I dey ask again, Israel pipol wey fall nor go get up again? No! But bikos of dia sins, Gentile pipol don get salvashon and dis tin, dey make Israel pipol jealous.
God wise well-well, so E nor let pipol for dis world know am with di wisdom wey dem get. Instead, E save only di pipol wey bilive di foolish message wey wi dey prish.
Make yu wosh as yu dey live yor life and di tins wey yu dey tish. Get patient, bikos if yu dey do like dis, yu go save yorsef and doz wey dey listin to yu.
Bikos God save and koll us to live holy life. E do like dis, nor bi sey wi deserve am bikos of wetin wi do, but na so E plan am even before di world start, so dat wey go know en grace thru Jesus Christ.
E kon save us. Nor bi bikos wi do good, but na bikos of en mesi. E forgive awa sins and E make us new shidren kon give us new life thru di Holy Spirit.
make yu know sey, di pesin wey bring yu wey bi sina kom back from di bad way, don save yor soul from deat and e don make Christ forgive yu all yor sins.