God sey, “Just as I komot Israel from my eye, na so too I go komot Judah pipol. I go rijet dis town wey I choose, both Jerusalem and di temple wey I sey, ‘I go stay.’ ”
“I bi Jew wey dem born for Tarsus wey dey Silisia, but na for dis town I for grow, I go skool and learn awa grand-grand papa dem law well-well under Gamaliel and I get mind to serve God well-well, just as una bi today.
I dey ask again, Israel pipol wey fall nor go get up again? No! But bikos of dia sins, Gentile pipol don get salvashon and dis tin, dey make Israel pipol jealous.
Na Hibru pipol dem bi? Misef na Hibru pesin too. Dem bi Israel pipol? Mi na Israel pesin too. Na Abraham bi dia grand-grand papa? Na dat same Abraham bi my grand-grand papa too.
Dem sekonsaiz mi eight days afta dem born mi. I kom from Israel, Benjamin tribe and I bi Hibru man. I bin dey live akordin to di law, bikos I bi Farisee.