8 But wetin e tok? “God word dey near yu. Di word wey wi dey prish near yu, e get faith and e dey yor mout and heart.”
I go give peace to evribody, both doz wey dey far and near! I go heal my pipol.
All di profets tok about am sey, ‘Evribody wey bilive am, thru en name, God go forgive dem.’ ”
Dem ansa am, “Bilive Jesus Christ and yu go save, both yu and all yor family.”
So, nobody go fit get faith wen e neva hear di message and na thru Christ word, wi go fit hear am.
Na di tin wey I won know from una, bi dis: Una receive di Spirit, bikos una dey do wetin di law tok or na bikos una bilive wetin wi prish give una?
Wetin make God give una di Spirit to do mirakle? Na bikos una do wetin di law tok or bikos una bilive wetin una hear?
so dat e go fit make am klean, thru baptizim and God word.
But di word and kommand dey here with una. Una know am and una fit read am, so make una obey am.
If yu give all dis kommand to di brodas and sistas, yu go bi good savant for Christ, bikos yu don feed yorsef with God word, wey bi di spiritual food and naim bi di good tishing wey yu dey follow.
God nor save una with human being body wey fit die, but na thru en word wey get life and dey forever.
but God word go last forever. And na dis word bi di Good News wey dem prish give una.