Who don go heaven kom back? Who don ever katch breeze for en hand or wrap wota for klot? Who kreate di whole world? Na who e bi and na wetin bi en pikin name? Make yu tell mi, if yu know!
Dis na di bread wey kom down from heaven, e nor bi like di bread wey una grand-grand papa dem chop and afta, dem still die. Di pesin wey go chop dis bread nor go ever die, but e go live forever.”
Na di faith wey pesin get for Jesus Christ go make am dey good for God eye. Anybody wey bilive Jesus, God dey make en faith strong, weda e bi Jew or Gentile pesin.
Na God give us Jesus Christ, so dat thru en blood, E go forgive us awa sins wen wi bilive Christ. God do dis to show sey before-before, E dey patient to forgive pipol dia sins.
Wen God promise Abraham and en shidren sey dem go inherit di whole world, E do am, nor bi bikos Abraham dey obey di law, but bikos e bilive God and God si am as raitious pesin.
kon bi one with am. My raitiousness nor kom from di law, but I dey raitious thru my faith for Christ. Bikos na thru faith God take make us dey raitious with am.
Na dis pikin bi God image and e dey show God glory. Naim dey keep evritin wey dey dis world with en pawa. Afta e don die make God for forgive evribody dia sins, e kon go sidan for God rite side for heaven.
Na faith make Noah build ark afta God warn am about wetin go happen. E obey wetin God tok and na di ark save en and en family. Na di same faith Noah take kondemn di world, kon inherit di raitiousness wey dey kom.