Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Romans 10:21 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

21 But Profet Isaya still tok about Israel pipol sey, “I don dey koll dis my sturbon pipol, but dem nor dey hear word.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Romans 10:21
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

But with all dis tins, di pipol go against Yu. Dem nor gri obey Yu and dem turn from yor law. Dem kill di profets wey kom warn and tell dem to turn kom meet Yu. Dem curse Yu many-many times,


I dey koll and invite una since, but una nor gri listin or hear mi.


Una nor go listin or hear, even doh God dey always send en savants kom meet una.


I send my savant, di profets kom meet una sey make una stop di bad tins wey una dey do kon do di korrect tin. Dem warn una sey make una nor woship and serve oda gods, so dat una go kontinue to stay for dis land wey I give una and una grand-grand papa, but una nor gri listin or hear dem.


So, mi wey bi Israel God dey sey, ‘I go distroy Judah and Jerusalem pipol, even don I bin don promise dem good tins. I go do am, bikos una nor dey gri listin to anytin wey I tok and wen I koll una, una nor dey ansa.’ ”


and dem go use en name prish give pipol make dem for turn from dia sin kom meet God and di prishin go start from Jerusalem.’


bikos I know as una sturbon rish. True-true, as I stay among una kon rish today, una still dey disobey God; so how una sturbones go kon bi wen I don die?


God still sey, “I don si sey dis pipol sturbon well-well!


Dem even try to stop us, so dat wi nor go prish di message wey go give salvashon to Gentile pipol. As dem dey do so, dia sins dey plenty more-more. But naw, God vexnashon with ponishment dey kom meet dem.


Na-im bi di rock wey dey fall pipol, bikos dem nor fit jump am pass. As dem nor bilive God word, dem bigin fall, bikos na so E plan sey e go bi.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ