Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Romans 10:17 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

17 So, nobody go fit get faith wen e neva hear di message and na thru Christ word, wi go fit hear am.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Romans 10:17
24 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Before, I know only wetin pipol tell mi, but naw, I don si Yu with my own eye.


Jesus kon tell dem, “Make una dey kareful for wetin una dey hear, bikos na wetin yu use take measure give oda pipol, na-im God go take measure for yu too and E go add join am.


Den Jesus sey, “Pipol wey hear God word and do wetin e tok, na dem God don bless!”


“Na wetin di parabol mean bi dis: Di seed na God word.


Jesus ansa, “My mama and brodas na pipol wey dey hear and obey God word.”


Wen John two disciples hear wetin e tok, dem kon follow Jesus.


I nor dey shame to prish God word, bikos na-im bi di pawa wey God take dey save doz wey bilive am, weda dem bi Jew or Gentile pipol.


How dem won take koll God make E help dem, wen dem nor bilive am? And how dem go fit bilive, wen dem neva hear about am? How dem go take hear about am, if nobody prish to dem?


Wi nor bi like odas wey dey do God word like sey na sometin wey dem fit sell; but bikos na God send us kom, wi dey tok di trut for en present, as Christ savant.


Na di tin wey I won know from una, bi dis: Una receive di Spirit, bikos una dey do wetin di law tok or na bikos una bilive wetin wi prish give una?


Wetin make God give una di Spirit to do mirakle? Na bikos una do wetin di law tok or bikos una bilive wetin una hear?


Make Christ word stay inside una and make una dey tish each oda with wisdom wey go make una heart strong. Make una dey sing psalms, hymns and spiritual song and dey do all dis tins to really tank God from una heart.


Wi still dey tank God evritime, bikos wen una asept God message wey una hear from us, una nor asept am like sey na human being message, but una asept am as God message and true-true na God message e bi and God dey work inside una wey don bilive.


Bikos dem prish God word give us, just as dem prish am give dem too. But dem nor take am sirious, bikos wen dem hear am, dem nor gri bilive am.


God nor save una with human being body wey fit die, but na thru en word wey get life and dey forever.


Mi John, I bi una broda and I dey follow una share from di trobol bikos of di kingdom and dey bear di sofa wey dey inside Jesus. Dem porshu mi go Patmos Island, bikos I dey prish God word and tok about Jesus Christ.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ