11 Bikos God word sey, “Anybody wey bilive am, nor go shame.”
Naw, dis na wetin God tok, “I dey put one foundashon stone for Zion and dem rite dis word put, ‘Di pesin wey bilive and get faith, make e nor fear.’
Kings go bi like una papa and kweens go bi like una mama. Pipol go bow dey honor una with respet. Den una go know sey na mi bi God, bikos I nor go disgrace anybody wey dey wait make I help am.”
But I go bless doz wey trust mi. Pipol wey bilive sey I go save dem.
If yu bilive and prish with yor heart give pipol sey Jesus Christ na Oga God, God go save yu.
God word sey: “Si, for Zion, I dey arrange stones wey go make pipol fall, yet doz wey bilive am, E nor go disappoint dem.”
God word sey, “Naw, I don lay one stone for Zion; di main stone wey I choose; no money fit buy am and anybody wey bilive am, nor go shame.”