Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Romans 1:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 God wey I dey serve and prish en pikin gospel, na-im fit bear mi witness sey I always dey remember una

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Romans 1:9
34 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

I know sey pesin dey for heaven wey go stand fight for mi.


Na so di gospel about Jesus Christ, God Pikin take start.


Den Jesus tell dem one parabol to show sey, e good make pipol dey always pray.


So as Pita dey prison, di pipol wey dey di church dey pray to God for am, day and nite.


Afta all dis tins happen, Paul kon sey e go-go Jerusalem thru Masidonia and Akaia. E plan sey, “Afta I don rish der, I go still go Rome.”


But I go let yu know sey I dey woship di God wey awa grand-grand papa dem dey woship, as dia tradishon tok (wey dis pipol sey na one kind gang). Dem bilive evritin wey di law tok and wey di profets rite down.


Bikos yestiday nite, God wey I dey serve, en angel appear to mi


So God don raiz en savant and E don send am give una, make e for bless and help una turn from sin kom meet am.”


Na di trut I dey tok, na Jesus get mi and di Holy Spirit dey bear witness for my mind sey, I nor dey lie wen I sey,


Na God bi my witness, bikos E know my heart! Na bikos I nor won disturb una naim make mi nor go Korint again.


God wey bi awa Oga God Jesus Christ Papa, wey dem go praiz forever, know sey nor bi lie I dey tok.


God dey si wetin I dey rite, bikos evritin wey I dey rite to una so, na true!


With difren prayers, make una dey ask God to help una. Make una always dey pray with di Spirit and dey shine una eyes well-well. Make una nor give up, but make una kontinue to pray for all God pipol.


Evritime wen I dey pray for una, I dey do am with happiness,


Una know how mi and Timoti bi, sey as pikin dey work with en papa, na so e dey follow mi work, so dat di gospel go stand.


Na wi bi di really sekonsishon; di pipol wey dey woship God thru en Spirit; pipol wey dey happy inside Christ and wi nor dey put awa hope for wetin pipol dey do.


Wen ever wi dey pray, wi dey always tank God for all of una.


Wi dey pray with all awa mind for day and nite sey, make God let us si una again kon let una know evritin wey una suppose know about una faith.


Na dis tins make God choose mi as prisha, apostle and tisha to Gentile pipol, so dat I go prish faith and wetin bi trut (na true word I dey tell una so, I nor dey lie).


Anytime I remember yu for my prayer, weda na for nite or day time, I dey always tank God wey I dey serve with betta mind, just as my grand-grand papa dem serve am.


Evritime wey I remember yu for my prayers, I dey tank my God,


As for mi, God forbid sey I nor go dey pray for una again, bikos dat na sin. I go tell una di tin wey dey good and wey dey make belle sweet God.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ