Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Romans 1:32 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

32 Aldo dem know sey God law sey, pipol wey dey live like dat go die, yet dem nor only dey do dis tins, but dem even dey support pipol wey dey do am.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Romans 1:32
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wen una si tifs, una go hail and klap for dem and una dey spend una time with pesin wey dey sleep with who e nor marry.


So pesin wey nor dey respet di law, dey praiz wiked pipol, but doz wey dey obey di law, nor like wikedness.


Di pipol dey deceive di king and en ofisas with all dia evil plans and di prince dem dey make di king happy with dia lie-lie words.


Dis show sey una support di tins wey una grand-grand papa dem do, bikos dem kill di profets and una build dia graves!


And wen dem kill yor savant Stefen, I stand der support dem kon keep dia koat for dem.’


Saul happy wen dem dey kill Stefen. Na from dat day trobol start for di church wey dey Jerusalem and all di bilivers kon skata go Judea and Samaria, but na only di apostles nor run.


Bikos of all di sins and bad tins wey wiked pipol dey do, God vexnashon dey show from heaven and di sins dey kover di trut.


Even doh dem know sey God dey, dem nor dey gri gi-am glory as God. Dem nor dey tank am for all di tins wey E dey do. Instead, na nonsense tins dem dey do and dia wiked mind nor fit undastand di trut again.


So wetin una gain from all doz bad tins wey una do? Na shame and deat doz tins dey bring.


Bikos, di reward for sin, na deat, but God gift wey Jesus Christ dey give us, na life wey nor dey end.


Den God go distroy dem, bikos dem enjoy sin instead of di trut.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ