Profet Jehu wey bi Hanani pikin go meet di king kon sey, “E dey good make wi help and follow wiked pipol wey hate God? Wetin yu do so, don make God dey vex for yu.
Di win wey yu win Edom pipol don dey won make yu kraze. Make yu stay for yor palis. Why yu won bring wahala kon give yorsef. Why yu won distroy yorsef and Judah tribe?”
But disgrace dey follow pipol wey dey woship juju; doz wey dey make mout about dia god wey nor bi anytin, bikos evry oda god must bow before di Oga awa God.
Nobody for di town dey respet dia papa or mama again. Una dey shit strenjas; wimen wey dia husband don die and shidren wey nor get papa and mama again.
From dat time go, Jesus kon dey tell en disciples sey, e go must enter Jerusalem where di eldas, priest oga dem and di law tishas go sofa and kill-am, but for di third day, e go wake-up.
Bikos na so Teudas still kom up before, dey tok sey en na pesin wey dey important and na about four hundred pipol follow am. Wen dem kill-am, all di pipol wey dey follow am skata and evritin kon end.
Wi nor dey boast anyhow about di work wey oda pipol do, but wi dey hope sey as una faith dey grow well-well, awa work among una go big, just as God share am give us,
Bikos I dey fear sey wen I kom, I nor go like wetin I go si and una nor go like as I go tok. I dey fear sey una go dey kworel, dey jealous each oda; dey vex; dey tink of only unasef; dey tok bad about each oda; dey do aproko; dey karry body up and dey bihave anyhow.
Pipol go dey tink of diasef alone; dey like money; dey boast; dey karry body up; dey tok bad about God; dey disobey dia papa and mama and dem nor dey tank even pipol wey do good for dem.
Before naw, wi dey bihave like fool; wi nor dey obey; wi dey deceive pipol; wi bi savant to tins wey dey sweet us; wi dey do bad tins and dey jealous odas; pipol hate us and wi hate dem too.
Na so di tongue bi too: naim small pass for di body, but di tins wey e fit do big well-well. Make una tink how small fire fit burn big forest rish groun.
Dis pipol dey komplain waka and dey find fault. Dem dey go anywhere wey dia body karry dem go and dem dey boast. Dem dey tok wetin pipol like to hear, so dat odas go praiz dem.