29 Wetin full dia mind na wikedness, evil tins, long-trot, bad belle, bad-bad tins; jealousy, to kill and fight, to lie, to keep enemy with pipol, to judge pipol waka,
But I dey tell una naw sey, anybody wey drive en wife komot from marriage, wey nor bi sey di woman sleep with anoda man, don make di woman kommit adultery and any man wey marry di woman, don kommit adultery too.”
Bikos I dey fear sey wen I kom, I nor go like wetin I go si and una nor go like as I go tok. I dey fear sey una go dey kworel, dey jealous each oda; dey vex; dey tink of only unasef; dey tok bad about each oda; dey do aproko; dey karry body up and dey bihave anyhow.
Before naw, wi dey bihave like fool; wi nor dey obey; wi dey deceive pipol; wi bi savant to tins wey dey sweet us; wi dey do bad tins and dey jealous odas; pipol hate us and wi hate dem too.