If man sleep with man like sey e dey sleep with woman, both of dem don kommit bad sin. So dem must kill two of dem and dia blood go dey for dia own head.
Una nor know sey wiked pipol nor go enter God kingdom? So make una nor fool unasef! Pipol wey dey sleep with who dem nor marry; doz wey dey serve juju; men wey dey sleep with oda men;
Make una use Sodom and Gomorrah and di towns wey dey near dem, as ezample. God ponish dem with fire wey nor dey end, bikos both men and wimen dey sleep with each oda anyhow, dem even dey sleep with animals and dem dey do oda wiked tins wey dey dia mind.