E just bi like sey dem dey chop ashes. Di foolish tins wey dem dey tink don deceive dem and dem nor fit help demsef again or tell demsef sey, ‘Nor bi lie-lie God wi dey serve so?’ ”
Yu trust yor wikedness kon sey, ‘Nobody dey si mi.’ Yor wisdom and di sense wey yu get dey deceive yu wen yu sey, ‘I dey special and nobody bi like mi.’
All dis bad tins kon turn di pipol to fool and dem nor get sense again. So, disgrace go follow doz wey dey make juju, bikos di juju na lie-lie and dem nor get life at-all.
But God sey, “My pipol foolish well-well, dem nor know mi at-all. Dem bi shidren wey nor get sense and dem nor dey kwik undastand anytin. Na only bad-bad tins dem sabi do.”
My friends, I nor won make una dey boast about unasef. So I go tell una wetin happen to Israel pipol. Some among dem sturbon well-well and na so dem go bi until di nomba for Gentile pipol wey God wont, don komplete.