Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Romans 1:21 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

21 Even doh dem know sey God dey, dem nor dey gri gi-am glory as God. Dem nor dey tank am for all di tins wey E dey do. Instead, na nonsense tins dem dey do and dia wiked mind nor fit undastand di trut again.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Romans 1:21
34 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

But di Oga God si as human being wikedness don strong for di eart. Evritin wey dem dey tink for dia mind, na how to do evil tins.


Di ofrin smell kon make belle sweet God, so E tell ensef, “I nor go ever curse di eart again, bikos of wetin human being do; even doh I know sey since wen I kreate dem, na only bad tins dem dey tink. I nor go ever distroy evritin wey get life as I don do so.


King Ben-Hadad ofisas kon tell am, “Na gods for mountin bi Israel pipol gods, naim make dem fit win us. But wi go win dem, if wi fight dem for ordinary groun.


Dem rijet en rules; di kovenant wey E make with dia grand-grand papa and di laws wey E sey make dem obey. Dem dey respet juju wey nor mean anytin and like dis, dem nor mean anytin to God again. Dem dey bihave like di kountries wey dey around kon make God dey shame for dem.


But to dey give tanks, na di kind sakrifice wey dey sweet mi for body. So if una follow my kommand, I go show una how God salvashon bi.”


So I let dem do di tins wey dey hongry dem to do kon live dia life di way dem wont am.


Oga God, all di nashons wey Yu make, go kom bow down for Yu and dem go praiz yor holy name,


But I still learn dis one too: God kreate evribody make dem dey good, but dem don dey do wiked tins as dem like.”


Even wen darkness kover evry oda nashon, God lite go shine on una own and en present wey brite well-well, go dey with una.


Den I sey, “My God! Na Yu dey protet and give mi pawa. Yu dey help mi anytime I dey for trobol. Nashons go kom from evriwhere for di eart kon sey, ‘Di gods wey awa grand-grand papa dem get, na only to lie dem know and dem nor fit save anybody.’


Na wikedness full human being mind and e bad well-well. Na who go fit undastand am?


God sey, “Wetin una grand-grand papa dem sey I do wey make dem waka leave mi? Dem go woship yuzles juju and e kon make dem dey yuzles too.


Instead, dem get strong heart kon dey woship Baal, just as dia grand-grand papa tish dem.


All dis juju don make Israel pipol turn from mi, but afta I don ansa dem, I bilive sey dem go turn back kom meet mi.


Den I give dem wiked laws and kommand wey nor dey give life.


But till naw, e nor ever gri sey na mi gi-am di korn, wine, olive oil and all di silva and gold wey e take dey woship Baal.


Na dis bi di rizin why God go judge di world, bikos lite don kom inside di world, but pipol like to stay for darkness instead of lite, bikos dem dey do tins wey nor good.


yu go open dia eyes make dem for waka komot from darkness enter lite. Make dem komot from Satan hand, go meet God, so dat God go forgive dem dia sins and dem go follow di pipol wey God don make klean, bikos dem bilive am.’


So God ponish dem, since dem know evritin wey dem suppose to know about God, bikos na-im show dem.


Since dem nor gri put God for mind and serve am, E kon leave dem make dem use dia bad mind dey do tins wey dem nor suppose do.


Make dia eye blind, so dat dem nor go fit si. Make wahala bend dia back forever.”


so dat Gentile pipol go praiz God sey e dey good to dem. Just as God word sey, “I go tell Gentile pipol about yu and I go sing, dey praiz yor name.”


For aftanoon, una go dey find road to pass like blind pipol and doz wey dey darkness and una go dey fail for evritin wey una dey do. Pipol go always dey tif una tin and opress una and nobody go save una.


Pipol go dey tink of diasef alone; dey like money; dey boast; dey karry body up; dey tok bad about God; dey disobey dia papa and mama and dem nor dey tank even pipol wey do good for dem.


Una know sey, God free una from di empty life wey una kollect from una grand-grand papa dem and E nor buy una with sometin wey fit spoil like silva or gold,


But God don choose una to bi en priest and holy pipol, so dat una go prish di Good News, bikos E koll una from darkness kon enter en brite lite.


Di angel kon shaut: “Make una dey fear and give God glory, bikos di time wey E go judge di world, don rish. And make una woship di Pesin wey make heaven, eart, sea and where wota from dey flow!”


Na who nor go fear and praiz yor name? Bikos na only yu dey holy. Pipol for evriwhere go kom woship yu, bikos dem dey si di good tins wey yu dey do.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ