2 Na dis gospel God promise us for en Holy Book thru en profets sey,
Dis tins go happen as God profet tok:
God promise en profet before-before
All di profets tok about am sey, ‘Evribody wey bilive am, thru en name, God go forgive dem.’ ”
And wi dey tell una di Good News about dis tins wey God promise awa grand-grand papa dem.
Naw, I stand make dem judge mi, bikos I put hope for di promise wey God make give awa grand-grand papa dem
but naw, dem don tok am at last. God wey nor dey die, kommand en profets make dem rite about di Good News, so dat pipol for evriwhere, go obey am and get faith.
E really dey good to sekonsaiz pesin! And wi know sey na Jew pipol God first give en message.
Naw, God don show us how wi go take dey good for en eye and nor bi thru di law, even doh na so Moses Law and di profets tok.
Di trut dey give dem di mind sey dem get life wey nor dey end and na God wey nor fit lie promise dem dis life even before E kreate di world.