Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Romans 1:17 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

17 Bikos na di Gospel dey show how God dey take make pipol klean for en eye. From di biginnin go rish di end, God sey, “Na only faith go make pesin dey klean for my eye.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Romans 1:17
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Pesin wey dey obey my kommand and keep my laws well. God wey get pawa sey, dat kind man dey raitious and e go get long life.


Si proud pipol, all wetin dem dey do nor dey good for my eye. But doz wey dey do good, go get long life, bikos dem dey obey my laws.


So Moses make snake with bronze kon put am on-top pole, so dat di pipol wey snake bite, if dem look di snake wey dem make with bronze, dem nor go die.


Pesin wey bilive di only pikin wey God get, go get life wey nor dey end. But pesin wey nor bilive Man Pikin, nor go get life at-all. God go always dey vex with dat kind pesin.”


as e bi sey dem nor know how God dey take make pipol good, instead, dem dey try to make demsef good by dia own pawa, since dem nor gri do wetin God wont.


Naw, God don show us how wi go take dey good for en eye and nor bi thru di law, even doh na so Moses Law and di profets tok.


Na di faith wey pesin get for Jesus Christ go make am dey good for God eye. Anybody wey bilive Jesus, God dey make en faith strong, weda e bi Jew or Gentile pesin.


But wot if some for dem nor gri bilive? Dat mean sey God dey lie?


Wetin wi go tok? Even doh Gentile pipol nor dey raitious before, dem don dey raitious naw, bikos of faith.


Bikos if glory dey for di law wey make God kondemn pipol, den di Spirit glory wey dey give life, na how E go betta rish?


Di One wey nor dey sin, God make am awa sin, so dat inside am, wi go kon dey good for God eye.


Dis one show sey, nobody dey good for God eye, bikos e dey obey di law. So anybody wey dey raitious, must live by faith.


kon bi one with am. My raitiousness nor kom from di law, but I dey raitious thru my faith for Christ. Bikos na thru faith God take make us dey raitious with am.


My raitious pipol go live and bilive, but if anybody turn back, I nor go dey happy with am.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ