“Di first one bi like lion wey get eagle feada. As I dey look am, dem remove di feadas kon karry am komot groun. Dem make am stand with two leg like human being kon gi-am human being mind.
“As I still dey look di horn, I si anoda small horn dey kom out from di big wons and three of di former horn kom skata make dis ones for fit kom out. Dis horn get eye wey bi like human being own and mout wey e take dey tok anyhow.
So I look kon si one white horse dey kom! Di pesin wey dey ride am whole bow and e wear crown for en head. E go fight and win many war and na champion e bi.