Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Revelashon 9:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 From inside di smoke, grasshoppa bigin enter di eart and dem give dem pawa like skorpion own.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Revelashon 9:3
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Yu go still tell dem, ‘My papa give una hard work do, but I go make di work hard pass as e bi before. Na ordinary kane e take flog una, but na koboko I go take dey flog una!’ ”


Yu go still tell dem, ‘My papa give una hard work do, but I go make di work hard well-well. Na ordinary kane e take flog una, but na koboko I go take dey flog una!’ ”


as di yong men advise am. E sey, “My papa give una hard work, but I go make una work hard well-well. My papa dey flog una with ordinary kane, but I go flog una with koboko!”


Awa enemies propaty dey skata like plant wey ant chop.


But yu, my pikin, even doh dem beat and do yu anyhow like sey yu dey stay with skorpions, make yu nor fear dem or anytin wey dem tok. Nor fear anytin wey dem tok or di way wey dem go dey look yu, bikos all of dem sturbon well-well.


Ants don chop all wetin wi plant and as one set dey go, anoda set dey kom, until dem go chop and distroy evritin wey remain.


Evry of una tin wey lokusts chop and distroy for doz years, I go give dem back to una, bikos na mi send doz lokust against una.


But know matter wetin una do, fire go still kill una; una enemies go kill una like lokust. Dem go kill evritin wey dem si and una nor go fit eskape, even if una plenty like many lokust.


Una prince and ofisas bi like plenty ant. Dem dey gada togeda for one place bikos di weda dey kold. But wons sun kom out, dem go fly go kon disappear!


Make una listin, I don give una pawa to waka on-top snake and skorpion and to ovakom all di enemy pawa, so nor-tin go fit wound una.


Na dis God take una pass di wildaness wey get wiked snakes and skorpions; place where wota nor dey. But God make wota flow for una from rock kon


E still tell dem, “Nor kill di pipol wey nor get God mark for dia forehead, but make una sofa dem for five monts with pain wey bi like skorpion own.”


Di grasshoppa bi like horse wey dey ready for war. Wetin dey dia head, bi like gold crown and dia face bi like human being own.


Midian and Amalek pipol and di men wey dey stay di desert, many for di valley like worm and dia kamel many like san-san for wotaside.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ