For dat day, darkness go kover di land and kloud go full evriwhere! Strong-strong sojas go kom and dem go bi like darkness wey spread kover di mountins. Dis kind tin neva happen before and sometin like dis nor go ever happen again.
Den di fift angel pour wetin dey en basin put for di beast throne, at wons, darkness kover di beast kingdom and di pain kon dey make dem bite dia tongue.
Den di fourt angel blow en trumpet and wen dem divide di sun, moon and stars into three, dem fall for one part and di part kon dark. So if dem divide day and nite into three, one part for di day nor get sun again and one part for di nite, moon and star nor kon dey shine again.
For my vishon, I still si many horse and doz wey dey ride dem: And di bullet proof wey dis pipol wear, red like fire kon get dark blue and yellow kolour. Di horse dem head bi like lion own and fire, smoke and sulfur, dey kom out from dia mout.