Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Revelashon 9:18 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

18 If dem divide di pipol for dis eart into three, di diziz wey bi like fire, smoke and sulfur wey dey kom out from dia mout, kill one part finish.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Revelashon 9:18
9 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den di third angel blow en trumpet and one big star from di sky fall kom from heaven like tosh wey dey bring fire. Wen dem divide evritin for di river into three, e fall for one part.


Di star name na “Bitterness.” So if dem divide di wota into three, one part betta and di wota kon kill pipol wey drink from am.


Den di fourt angel blow en trumpet and wen dem divide di sun, moon and stars into three, dem fall for one part and di part kon dark. So if dem divide day and nite into three, one part for di day nor get sun again and one part for di nite, moon and star nor kon dey shine again.


Di first angel blow en own and dem kon trow stone with fire wey mix with blood kom di eart. So if dem divide di eart into three, one part burn finish. And if dem divide di trees wey dey di eart into three, one part with all di green grass, burn finish too.


Den di sekond angel blow en trumpet and dem trow mountins wey fire dey, enter di sea. If dem divide di sea into three, one part kon turn to blood.


And wen dem divide evritin wey get life for di sea into three, one part die finish. Den wen dem divide all di ship for di world into three, one part burn finish too.


If dem divide di pipol for dis eart into three, dem release di angels wey dem don prepare for dis hour, day, mont and year, sey make dem go kill one part finish.


For my vishon, I still si many horse and doz wey dey ride dem: And di bullet proof wey dis pipol wear, red like fire kon get dark blue and yellow kolour. Di horse dem head bi like lion own and fire, smoke and sulfur, dey kom out from dia mout.


Di horse pawa dey for dia mout and tail. Dia tail mout bi like snake own and dem get pawa to wound and kill pipol.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ