Babilon king, yu wey bi di morning star wey dey shine; make yu si as yu fall from heaven, just as devil fall! Before-before, yu katch many pipol, but naw, dem don trow yu for groun.
Di seven stars wey yu si for my rite hand, na dia sekret bi dis: Di stars na di angels for di seven church and di seven lampstand, na di seven church.”
Di beast wey yu si, dey before, but e nor dey again and e go soon raiz kom from di pit kon start to distroy. Den doz pipol for eart wey dia name nor dey for di Life Book, go fear di beast.
Den di third angel blow en trumpet and one big star from di sky fall kom from heaven like tosh wey dey bring fire. Wen dem divide evritin for di river into three, e fall for one part.
Den di fourt angel blow en trumpet and wen dem divide di sun, moon and stars into three, dem fall for one part and di part kon dark. So if dem divide day and nite into three, one part for di day nor get sun again and one part for di nite, moon and star nor kon dey shine again.