Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Revelashon 8:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 Den di sekond angel blow en trumpet and dem trow mountins wey fire dey, enter di sea. If dem divide di sea into three, one part kon turn to blood.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Revelashon 8:8
13 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Babilon! Yu bi like mountin wey distroy di whole world, but mi wey bi God, na una enemy. I go katch, skata and burn una to ashes.


“If any profet give una wrong massage, make una know sey na mi wey bi God do am like dat. But I go still rijet and remove am from among my pipol for Israel.


God kon show mi anoda strong vishon. For dis vishon, I si as E dey ready to ponish en pipol with fire. Di fire burn di big sea, den e kon start to burn di land.


and if dem divide all di pipol wey dey di land into three, two part go die finish.


I go test di third part wey survive kon klean dem, just as dem dey klean silva for fire. I go test dem, just as dem dey test gold. Den dem go pray give mi and I go ansa dem. I go tell dem sey dem bi my pipol and dem go sey, ‘Na di Oga bi awa God.’ ”


I tell una true word, if anybody tell dis mountin, ‘Komot from here go enter di sea’ and di pesin nor get doubol mind, but bilive sey wetin e tok go happen, God go do am for am.


Dis two men get di pawa to klose di sky, so dat rain nor go fall as dem dey profesai. Dem still get di pawa to turn wota to blood and to kause bad tins to happen for di eart.


If dem divide di sky into three, di dragon tail swip one part komot kon trow dem kom di eart. E stand for di woman front as e won born and e dey wait to kill di pikin wey di woman won born.


Di first angel blow en own and dem kon trow stone with fire wey mix with blood kom di eart. So if dem divide di eart into three, one part burn finish. And if dem divide di trees wey dey di eart into three, one part with all di green grass, burn finish too.


If dem divide di pipol for dis eart into three, dem release di angels wey dem don prepare for dis hour, day, mont and year, sey make dem go kill one part finish.


If dem divide di pipol for dis eart into three, di diziz wey bi like fire, smoke and sulfur wey dey kom out from dia mout, kill one part finish.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ