God take am go outside kon sey, “Look di sky and yu go si di stars, den try if yu fit kount dem!” Den God sey, “Na as di stars bi for up, na so yor shidren go plenty rish.”
Jesus ansa am, “I tell yu true word, for dat time wen evritin go dey new, Man Pikin go sidan for en throne wey get glory and una wey dey follow mi, go sidan for twelf thrones, dey judge di twelf tribes wey dey Israel.
sey, awa twelf tribes go gain as dem dey use all dia mind dey serve God, both day and nite. My king, na bikos of dis hope wey I get, naim make di Jew pipol dey akuiz mi so!
Dem kon dey sing new song for di throne, di for creatures and di eldas front. Nobody fit learn di song, escept di 144,000 pipol wey God save from dis eart.