As Jesus dey tish for di temple, e kon shaut sey, “Una know mi and di place wey I from kom, nor bi my pawa I take kom, na God wey send mi naim bi di korrect Pesin. But una nor know am.
Wen Pita si sey all di pipol gada, e kon start to dey prish, “Israel pipol, wetin make dis mirakle dey sopraiz una like dis? Why una dey look us like sey na with awa own pawa or holiness wi take make dis man waka?
Den one among di eldas kon tell mi, “Make yu nor kry again! Look, di lion for Judah tribe, wey kom from David family, don win. So e go open di book and break di seven keys.”
Afta all dis tins, I look up kon si crowd wey nobody fit kount. Dem kom from difren tribe, kountry, group, language and dem stand for di throne and di Lamb front. Dem wear white klot kon whole palm tree branches for hand
Den di woman run go tell en husband, “One man from God appear to mi! E look like God angel and if yu si am, yu go fear. I nor ask am where e from kom and e nor tell mi en name.