Revelashon 6:16 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
16 Dem kon dey kry give di mountin and di rock sey, “Make yu fall on-top us and hide us from di Pesin wey sidan for di throne and make yu hide us from di Lamb vexnashon.”
Dem go skata di juju house on-top di hill for Aven where Israel pipol for dey go woship am. Shuku-shuku and grass go grow kover dia altars. Di pipol go shaut koll di mountins sey, “Make yu kom hide us!” Dem go tell di hill, “Make yu kom kover us!”
So Jesus vex kon look dem round, bikos dia heart strong well-well, den e tell di man, “Stresh yor hand.” So di man stresh en hand and di hand kon well again.
E swear with di Pesin name wey go dey forever and ever. Na dis Pesin kreate di heaven, eart, sea and evritin wey dey inside dem, den di angel kon sey, “Time go soon rish!”
One sharp swod dey kom out from en mout and e go take am distroy all di kountries. E go rule dem with strong hand and E go mash di grapes wey dey bring wine with strong vexnashon, bikos na God get all di pawa.
Lite dey shine kom out from di throne and tonda dey make nois from am too. For di throne front, seven tosh wey get fire dey burn for der. Dis na God seven spirit.
Dem dey kry with loud vois sey, “Oga God wey get pawa, how long e go take before yu go judge doz wey dey live for dis eart? Make yu ponish dem, bikos na dem kill us!”