Wen day break, John si Jesus dey waka kom meet am, den John sey, “Make una look! Dis na di Sheep wey God send kom die, so dat God go forgive us awa sins.”
Den for heaven, God Temple kon open and en Kovenant Box dey inside di temple. Tonda kon dey make nois and spark, den strong eartkweke happen and big-big ice-blok kon dey fall.
Each for di for creatures get six feada and eye full di feadas. Dem nor dey ever rest for nite or day and dem dey always sey: Holy! Holy! Holy! Na-im bi di God wey dey mighty. Di Pesin wey dey since, wey dey naw and wey go soon kom.
And wen e take di book, di for creatures and di twenty-four eldas fall for di Lamb front. Each of dem whole harp and basin wey incense full. Dis incense na God pipol prayers.
Den wen di Lamb open di third one, I hear di third creature dey sey, “Make yu kom!” So I look and I si one black horse dey kom! Di pesin wey dey ride am hold ruler for en hand.