Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Revelashon 5:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 As I dey look, I kon hear many tazon angels vois as dem stand round di throne; di for creatures and di eldas.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Revelashon 5:11
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Mikah still sey, “Naw, make yu listin to wetin God tok! I si God wey sidan for en throne for heaven with all en angels as dem stand near am.


So angels, make una praiz God: Di strong angels wey dey obey am and listin to all en kommand.


Make all en angels praiz am! Make all di sojas for heaven, praiz am!


Wen Oga God appear to en pipol for Mount Sinai, E kom with angels and shariot wey nobody fit kount.


River with fire dey kom out from di throne. Pipol wey dey woship am, many well-well. Many-many pipol still dey wait to kom woship am. Den dem open di book, bikos dem won start to judge kase.


“God kom from Mount Sinai and E show ensef to Israel pipol for Seir; E shine kom from Mount Paran and E kom with 10,000 holy ones. Na en rite hand E take give dem en law.


Instead, una don kom Mount Zion; di town where God dey stay; di Jerusalem for heaven where tazon angels dey. Una don enter di assembly,


Enoch wey bi di nomba seven pesin afta Adam, profesai about dis pipol. E sey, “Listin! God dey kom with en holy pipol wey nobody fit kount and


Den I hear many pipol vois wey bi like river and tonda nois dey shaut: “Halleluya! Na awa Oga God wey get all pawa dey rule!


Twenty-four oda thrones dey round di first throne and twenty-four eldas sidan put for di thrones. Dem wear white klot and gold crown dey dia head.


Di throne front dey shine like mirror and e bi like crystal. For centre and around di throne, for creatures wey get eye full body, dey for der too.


And di for creatures kon sey, “Amen!” Den di eldas fall face groun kon start to woship God.


Den I si one Lamb wey bi like sey dem don kill-am, but e stand for di throne centre with di for creatures and di twenty-four eldas. E get seven horns and seven eyes wey bi God seven spirit, wey E send enter di eart.


And wen e take di book, di for creatures and di twenty-four eldas fall for di Lamb front. Each of dem whole harp and basin wey incense full. Dis incense na God pipol prayers.


And all di angel stand round di throne; di eldas and di four creatures. Dem fall face groun kon bigin woship God.


I hear as dia sojas many rish and dem many rish 200,000.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ