Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Revelashon 5:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 Yu don choose dem as kings and priests wey go serve God and dem go rule for di eart.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Revelashon 5:10
9 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Una go bi my kingdom priests and holy nashon wey dem dedikate give mi.’ Dis na wetin yu go tell Israel pipol.”


And di pipol wey dey serve di Most High God go get royal pawa wey go dey forever and ever.’


Di pawa and great tins wey di world get, God kom gi-am to pipol wey dey serve am. Dia royal pawa nor go ever end and rulers go serve and respet dem.’


di one wey give us betta kingdom kon make us priest wey go dey serve God wey bi en Papa, make glory and pawa bi en own forever and ever! Amen.


Den I si thrones and pipol wey God don give authority to judge, sidan on-top di thrones. Doz wey dem kut dia head komot bikos of di trut about Christ and God word, I still si dem too. Dis ones nor woship di beast or en image and dem nor gri make dem put en mark for dia fore head or hand. Dis pipol raiz-up kom life kon rule with Christ for 1,000 years.


God don bless di holy pipol wey join for di first resureshon! And dis pipol nor go die again, but dem go bi God and Christ priests and dem go rule with am for 1,000 years.


Nite nor go dey again and dem nor nid lantan or sun lite, bikos God go bi dia lite and dem go rule forever and ever with am.


Bikos I bear rish di end kon follow my Papa sidan for en throne, anybody wey fit bear rish di end, go follow mi sidan for my throne too.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ