Judah my pikin, yu bi yong lion wey just chop wetin e kill finish. Yu dey kill like lion kon kwayet dey look; yu bi like woman lion, na who go fit fight am?
But pipol wey dey wait for God to kom help dem go get new strent and pawa. Dem go fly high like eagle; even wen dem run, dem nor go taya and wen dem waka, dem nor go faint.
Each creature get four face. Di first one face na, angel own, di sekond one, na human being own, di third one, na lion own and di fourt one, na eagle own.
“Di first one bi like lion wey get eagle feada. As I dey look am, dem remove di feadas kon karry am komot groun. Dem make am stand with two leg like human being kon gi-am human being mind.
Di nashon bi like strong lion; wen e dey sleep, nobody fit wake am. Anybody wey bless Israel pipol, go dey bless and anybody wey curse Israel pipol, curse go follow am.’ ”
My brodas and sistas, make una stop to tink like small shidren. Instead make una dey tink like mature pipol and dey innocent like pikin wey dem just born.
Den wen di Lamb open di third one, I hear di third creature dey sey, “Make yu kom!” So I look and I si one black horse dey kom! Di pesin wey dey ride am hold ruler for en hand.