Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Revelashon 3:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Make yu remember wetin yu don hear and receive and make yu obey dem kon turn from sin kom meet God. If yu nor shine yor eye well, I go kom like tif and yu nor go know di time wen I go kom.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Revelashon 3:3
24 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den una go remember all di yeye tins wey una do and di bad ones wey una do with una body. Una go vex for unasef, bikos of all di bad tins wey una bin do.


Wen una remember di wiked and wrong tins wey una do before, una go hate unasef, bikos of una sins.


“So, make una dey ready, bikos una nor know di day or time wen Christ go kom.”


Make una dey wosh and shine una eye, bikos una nor know wen di time go rish.


If not, e go fit kom back wen una nor espect and e go meet una dey sleep.


Bikos una really know sey, di day wen Christ go kom, e go bi like wen tif dey kom for nite.


Timoti, make yu guide wetin God give yu well-well. Nor put yor mout for yeye tins or matter wey pipol wey nor know God dey tok and do, bikos dem dey oppoz yu with wetin dem feel sey dem know.


Make yu kontinue with di word wey I tell yu kon dey do am with di faith and love wey dey inside Christ.


Make wi listin to wetin wi don hear, so dat wi nor go fall komot from di rite road.


As long as I dey, I look am sey e good make I dey remind una,


My friends, dis na di sekond leta wey I dey rite to una, so dat una go dey tink about di tins wey I tell una.


Di day wen God go kom, go bi like wen tif dey kom for nite. Wen E kom, di heaven go disappear with loud nois and di stars for up go melt, di whole eart and evritin wey dey inside, go vanish.


Look! I go kom like tif! God don bless di pesin wey go shine en eye and wear en klot, so dat e nor go naked waka.


So, make yu remember where yu from fall and turn from sin kom meet God, den bigin do di tins wey yu first dey do. If yu nor gri turn from sin kom meet God, I go remove yor lampstand from where e dey.


(Si! I go soon kom! God don bless di pesin wey go obey di profesy wey dey dis book.)


I go soon kom. Make yu whole wetin yu get well-well, so dat nobody go take yor crown from yu.


I dey korrect and ponish anybody wey I love. So make yu dey sirious kon turn from sin kom meet God!


So make yu raiz-up kon give pawa to di remainin tins wey don nearly die, bikos yor work nor dey good for God eye.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ