Revelashon 22:18 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
18 I dey warn evribody wey dey read di profesy wey dem rite for dis book: If anybody add join wetin dey dis book, di wahala wey dey dis book, God go add am join en life.
Make nobody shit en Christian broda or make am vex, bikos na God go fight for di pesin wey yu shit and wi don tell una before and wi still dey warn una sey, God go really ponish pipol wey dey do like dat.
Di pesin wey go read dis profesy give pipol, God go bless am. God go bless doz wey dey listin and do wetin dem rite for di profesy, bikos di time don near.
Den di seven angels wey whole di seven last wahala kon kom out from di temple and dem wear klean klot wey dey shine well-well, kon tie gold belt for dia chest.
So dem seize di beast and di fake profets wey dey help am do mirakles to deceive pipol wey kollect di beast mark and woship en image. Den dem trow dem two inside di fire wey sulfur dey and di fire burn dem alive.
“Mi, wey bi Christ, I don send my angel make e kom tell di pipol for di church di trut about dis tins. I kom from David family and na mi bi di brite Star wey dey shine for morning!”
But e tell mi, “Nor do like dat! I bi savant like yu, like yor brodas di profets and doz wey go obey di words wey dey dis book. So make wi woship only God!”
“Make yu rite di tins wey I won tell yu naw, go give di angel for di church wey dey Laodicea: ‘Dis message na from di Pesin wey bi di Amen; di witness wey dey obey God kommandment since E kreate di world.