Den God go kover and guide Mount Zion with all di pipol wey gada der with kloud for day time and fire for nite. Yes! God glory go kover and protet di whole town.
On-top di flat crystal wey dey dia head, e get one tin wey bi like throne wey dem make with safaya. On-top di throne, wetin dey der, bi like human being.
Yu just dey busy dey buy and sell and dis tins kon make yu dey misbihave and kommit sin. So I ask yu make yu komot from my mountin wey dey holy and di angel wey dey guide yu, porshu yu komot from di stone wey dey inside fire.