“God ask, ‘How yu wont take deceive am?’ “Di spirit ansa, ‘I go make all di profets lie for Ahab.’ “God kon sey, ‘Make yu go deceive am, bikos e go hear yu.’ ”
I go make my savant, David shidren-shidren and all di priest from Levi tribe plenty, so dat dem nor go fit kount dem, just as dem nor fit kount star for sky or san-san for wotaside.”
Na dem bi demon spirit wey dey do mirakle. Na dem dey go gada all di kings wey dey for di world, so dat dem go fight di fight wey go happen for di day wey God Almighty go judge di world.
Den di angel trow am put for di pit kon lock di door with key, so dat e nor go fit deceive pipol until di 1,000 years don komplete. (Afta dis tins, dem must free am for short time.)
Filistia pipol gada to fight Israel pipol; dem get 3,000 shariot, 6,000 men for horse and dia sojas plenty like san-san wey dey wotaside. Dem kon go kamp for Mikmash wey dey di east side for Bet-Aven.