God pipol wey don die, go kom back to life! Dia body go raiz-up again. So, all of una wey dey grave, make una wake-up kon shaut with happiness, bikos una go grow well like grass wey dew fall put and di eart go bring back evritin wey don die.”
I nor go save dis pipol from grave or save dem from deat pawa. So deat, make yu bring all yor wahala kom! Yu grave, make yu bring all yor distroshon kom, bikos I nor go pity for dis pipol again.
Una wey bi Kapanaum pipol, una feel sey una fit karry unasef go heaven? No! God go trow una for hell-fire, bikos if to sey dem do di mirakles wey dem do for una, for inside Sodom, di town for still dey till today.
And I si di pipol wey don die, both big and small, as dem stand for di throne front. Dem open plenty books and den kon open anoda book wey bi di Life Book. And dem judge doz wey don die akordin to wetin dem rite for di books sey dem do.
So I look kon si one horse wey en kolour bi like green wey don dey fade! Di pesin wey dey ride am, na Deat dem dey koll am and en friend na di Grave. Wen dem divide di eart into four, dem give di two of dem pawa ova one part, so dat dem go kill pipol with dia swod; honga; diziz and wiked animals.