Babilon king, yu wey bi di morning star wey dey shine; make yu si as yu fall from heaven, just as devil fall! Before-before, yu katch many pipol, but naw, dem don trow yu for groun.
Afta dat one, wi bilive wetin di profets prish. Una go do well if una hear and follow di lite wey dey shine for darkness and wen day break, di star wey dey kom for morning, go shine for una heart.
My friends, wi bi God shidren naw and wi neva know as wi go bi wen Christ go kom back. But wi know sey wi go bi like am, bikos wi go si am just as E bi.
“Mi, wey bi Christ, I don send my angel make e kom tell di pipol for di church di trut about dis tins. I kom from David family and na mi bi di brite Star wey dey shine for morning!”