Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Revelashon 2:27 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

27 E go rule di nashons with iron rod kon break dem to pieces like pot.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Revelashon 2:27
12 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Just as sheep dey waka like mumu, na so too dem go dey waka until dem enter dia grave; di place where Deat go bi dia shepad and oga. For morning, pipol wey dey fear God go rule ova dem. Dia body go rotin for grave wey nor even dey near dia fine house.


E go skata for groun like pot wey break to pieces and nobody go fit pick or arrange am again.”


kon tell dem, ‘Oga God wey dey mighty sey, “Just as Jeremaya take distroy dis pot, na so too I go distroy dis town and di pipol wey dey stay inside. Dem go beri pipol for Tofet, until place nor go dey again to beri pipol put.


And di pipol wey dey serve di Most High God go get royal pawa wey go dey forever and ever.’


until God wey dey live forever kon judge and favor all en holy shidren. Den di time kom rish for God to take-ova di kingdom.


“My Papa put evritin for my hand. Nobody know di pikin, but na only en Papa know am. Nobody know di Papa, but na only di pikin and anybody wey di pikin choose to show.


So, I give una pawa to rule, just as my Papa don give mi.


Papa, I wont make di pipol wey yu give mi stay with mi for where I dey, so dat dem go si di glory wey yu give mi, bikos yu love mi before yu kreate di world.


Di woman born boy wey go rule di world with strong hand. But dem take di pikin kon go gi-am to God for en throne.


One sharp swod dey kom out from en mout and e go take am distroy all di kountries. E go rule dem with strong hand and E go mash di grapes wey dey bring wine with strong vexnashon, bikos na God get all di pawa.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ