Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Revelashon 2:25 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

25 Make una whole wetin una get until I kom.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Revelashon 2:25
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wen I don finish, I go kom take una, so dat una go stay with mi for where I dey.


One among dem wey en name bi Agabus, get up and di Holy Spirit kon put word for en mout sey, “Heavy honga go happen for di whole world.” Dis tin happen di time wen Klaudius dey rule.


Make wi love each oda well-well. Make una hate anytin wey dey bad, but una must love anytin wey get trut.


Jesus mean sey, wen una chop di bread kon drink from di cup, una dey tell odas about Christ deat until e go kom back.


So, make una nor judge anybody until Christ go kom back. E go espose evritin wey dey darkness and di tins wey dey inside pesin heart. Dat time, na God go praiz evribody akordin to wetin dem do.


So make wi whole di hope wey wi get strong well-well, bikos God wey promise us dey always keep en promise.


But as God Pikin, Jesus dey faithful for God house. So wi too go get share for di house if wi bilive and get konfident for awa hope wey dey inside Christ.


Jesus wey bi God Pikin, na-im bi awa High Priest wey don go heaven. Make wi hold am tait and always dey bilive am.


Di day wen God go kom, go bi like wen tif dey kom for nite. Wen E kom, di heaven go disappear with loud nois and di stars for up go melt, di whole eart and evritin wey dey inside, go vanish.


(Make una look! E dey kom back inside di kloud and evry eye go si am. Even doz wey shuk am and all di tribes wey dey dis eart, go kry bikos of am. Dis tins go really happen! Amen.)


Di Pesin wey dey tok dis tins, know sey dis tins na true. Jesus Christ sey, “True-true, I go soon kom!” Amen! Oga God Jesus, make yu kom!


(Si! I go soon kom! God don bless di pesin wey go obey di profesy wey dey dis book.)


I go soon kom. Make yu whole wetin yu get well-well, so dat nobody go take yor crown from yu.


Make yu remember wetin yu don hear and receive and make yu obey dem kon turn from sin kom meet God. If yu nor shine yor eye well, I go kom like tif and yu nor go know di time wen I go kom.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ