May bi, if Judah pipol hear di way I won take distroy dem, dem go shange from all di bad-bad tins wey dem dey do, den I go forgive all dia sin and wikedness.”
Tell dem sey, ‘God sey, “As long as mi wey get pawa dey alive, I nor dey happy to si doz wey dey sin, dey die. I prefer make dem stop to sin, so dat dem go get life wey nor dey end. So, Israel pipol, make una stop di wiked tins wey una dey do. Na wetin make una won kill unasef finish?” ’
God sey, “I bin tink sey, ‘Una go really respet mi!’ Naw, make una do wetin I tok! If to sey una really gri do am, dem nor for skata una house with all dis ponishment.” But na only to sin una dey tink about.
I dey fear sey wen I kom again, God go disgrace mi for una front. And I go kry, bikos many of una still dey sin. Una neva turn from sin kom meet God; una neva turn komot from di ashawo and yeye life wey una dey live.
Bikos en sin bi like drink wey dey shark pesin and na-im make dem dey sleep with who dem nor marry. Na dis make am fall and all di kings for dis eart don sleep with am and many tradas don get plenty money, bikos of di yeye life wey e dey live.”
So, make yu remember where yu from fall and turn from sin kom meet God, den bigin do di tins wey yu first dey do. If yu nor gri turn from sin kom meet God, I go remove yor lampstand from where e dey.