Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Revelashon 2:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 I know yor work. I don si evritin wey yu do and even as yu dey wait with patient. I know sey yu nor like wiked pipol. Yu don test pipol wey sey dem bi apostles, but dem nor bi, bikos yu si sey, dem dey lie.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Revelashon 2:2
21 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

True-true, God dey guide en pipol for evritin wey dem dey do, but E go distroy doz wey nor dey follow en ways.


Dat time, I go sey, ‘I nor know yu. Make yu komot from where I dey, yu wey wiked well-well.’ ”


Jesus tok dis one make e for si wetin Filip go do, bikos en ensef know wetin e won do.


Nor bi sey anoda gospel really dey, but some pipol dey disturb una, bikos dem won shange wetin wi prish about Christ.


So make wi nor bi like shidren wey breeze dey karry up-and-down; shidren wey dey follow yeye tins wey human being dey tish and na dis tins dem dey take deceive pipol.


Wi remember di work wey una don do thru faith and as una dey bear bikos of di hope wey una get about awa Oga God Jesus Christ.


But God strong foundashon still stand and dem rite put sey, “God know en pipol and evribody wey bi Christ own, must stop to do evil.”


God nor dey support pipol anyhow. E go remember how una help en pipol before-before and how una still dey help dem naw. Una bi God pipol and E nor go forget di love wey una show en shidren.


My friends, make una nor bilive evribody wey sey na God Spirit dey tok thru am. Una must test am to know weda na God Spirit e really get. Bikos many fake profets dey for dis world.


So, make yu remember where yu from fall and turn from sin kom meet God, den bigin do di tins wey yu first dey do. If yu nor gri turn from sin kom meet God, I go remove yor lampstand from where e dey.


But all dis tins dey happen make e for betta for yu, bikos yu hate di tins wey Nikolaitan pipol dey do and I hate doz tins too.


I know di sofa wey yu sofa and how yu nor get money, but yu get enough money. I still know di bad tins wey dem tok about yu. Dem sey dem bi Jew pipol, but dem nor bi Jew, bikos dia sinagog, na Satan own.


“Make yu rite di tins wey I won tell yu naw, go give di angel for di church wey dey Sardis: ‘Di Pesin wey whole God seven spirits and di seven stars: I know wetin yu dey do; for pipol eye, yu dey alive, but true-true, yu don die.


I know evritin wey yu do. Yu nor dey hot or kold. I wish sey yu hot or kold!


I know evritin wey yu dey do. (Si, I don open door for yu wey nobody go fit klose.) I know sey yu nor too get pawa, but yu don obey my word and yu nor deny mi at-all.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ