Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Revelashon 2:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 “Make yu rite di tins wey I won tell yu naw, go give di angel for di church wey dey Pergamum: ‘Dis na di message from di Pesin wey whole di swod wey get two sharp side.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Revelashon 2:12
10 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

E go judge evribody akordin to wetin dem do kon defend doz wey nobody dey help. E go ponish wiked pipol and doz wey dey do bad tins, go die.


E make my words sharp like swod and betta arrow wey E fit use anytime kon hide and protet mi with en hand.


God word dey alive, e get pawa and e sharp pass knife wey get two sharp side. Di word dey divide pesin soul from en spirit and e dey divide bone from bone; bikos God know wetin wi dey tink for awa mind.


“Make yu rite evritin wey yu dey si inside dis book, den send dem go meet di pipol wey dey di seven church wey dey for Efesus, Smyrna, Pergamum, Tiatira, Sardis, Filadelfia and Laodicea.”


E whole seven stars for en rite hand and swod wey get two sharp side, dey kom out from en mout. En face dey shine like sun.


One sharp swod dey kom out from en mout and e go take am distroy all di kountries. E go rule dem with strong hand and E go mash di grapes wey dey bring wine with strong vexnashon, bikos na God get all di pawa.


Dem take di swod wey dey kom out from di Pesin wey dey ride di horse mout, kon kill di odas, den all di birds chop dia body till di beleful.


“Make yu rite di tins wey I won tell yu naw, go give di angel for di church wey dey Efesus: ‘Di Pesin wey whole di seven stars for en rite hand and dey waka round di seven lampstand, dey tell di pipol for di church sey:


So, make yu turn from sin kom meet God! If not, I go kwik-kwik kom fight yu with di swod wey dey my mout.


Ehud make swod wey get two mout and e long small. E hide am for di rite side under en klot.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ