Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Revelashon 19:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 bikos en judgement dey true and korrect. E don ponish dat ashawo wey spoil di world with en sins, as e dey sleep with who e nor marry and God don revensh am for Christ savants wey e kill!”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Revelashon 19:2
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Yu go distroy yor oga, Ahab family. I go revensh Jezebel bikos of my savants, di profets wey e kill.


To fear God dey good, bikos e dey give pesin hope forever. God laws korrect and dem dey okay.


Oga God, na Yu bi my God! I go praiz yor name kon show as Yu good rish, bikos Yu don do wonderful tins and na as Yu tok before-before, na so Yu do am.


“ ‘But di kourt for heaven go sidan judge am kon take en pawa komot for en hand, den dem go distroy am finish.


I go revensh and pay dem back wen dem go fall, bikos di day wen wahala go kom meet dem, don near well-well and dia judgement don almost full!”


Na-im bi di Rock; evritin wey E dey do dey korrect, bikos wayo nor dey en tins. En na God wey pesin fit bilive, bikos E nor just dey judge pipol anyhow.


My pipol, make una happy, bikos God go fight for en savant; E go pay en enemies back kon sorry for en pipol and dia land.


Dem dey sing Moses wey bi God savant and di Lamb song sey: “God wey dey mighty, si as di tins wey yu dey do dey big and wonderful! Yu wey bi king for all nashons. Yu nor dey do parsha and evritin wey yu dey do, na true.


Evribody wey dey heaven, God pipol, di apostles and profets, make una happy bikos God don judge and kondemn am bikos of una!”


Bikos en sin bi like drink wey dey shark pesin and na-im make dem dey sleep with who dem nor marry. Na dis make am fall and all di kings for dis eart don sleep with am and many tradas don get plenty money, bikos of di yeye life wey e dey live.”


Dem dey kry with loud vois sey, “Oga God wey get pawa, how long e go take before yu go judge doz wey dey live for dis eart? Make yu ponish dem, bikos na dem kill us!”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ