Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Revelashon 18:24 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

24 God pipol, di profets and doz wey yu kill for dis world, God don si dia blood inside yu.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Revelashon 18:24
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Poor and innocent pipol blood don stain una klot, even doh una nor katch dem dey tif for una house. Yet, with all dis tins wey una don do,


Na Babilon kill many pipol for dis world. Yes! Babilon go fall, bikos na-im make many Israel pipol die. Mi, wey bi God, don tok.”


Some of una dey kill pipol, bikos of money. Some dey put intrest for di money wey dem borrow dia kountry man and dem dey get plenty gain thru dat one. Dem don forget mi.” Dis na wetin God wey get pawa tok.


Pipol wey dey rule bi like wolf wey tear animal into too. Dem dey kill pipol, so dat dem go get money.


Some of una dey lie for pipol head, so dat dem go kill dem. Some dey chop food wey dem don sakrifice give juju and some like ashawo life.


As I still dey look, di horn kon dey fight and distroy God pipol,


E go tok against God kon opress anybody wey dey serve God. E go try to shange laws, festivals and di pipol wey dey serve God, go dey under am for three and half years.


“E go bad for una wey dey tish di law and una Farisee pipol, una wey dey pritend! Una bi like grave wey fine for outside, but di pesin body for inside, don rotin.


So all God pipol blood wey una kill for dis world, go dey una head. From Abel blood go rish Zekaraya wey bi Barakaya pikin, wey una kill for inside di temple.


E get any profet wey una grand-grand papa dem nor kill? Dem even kill di messenja wey tok before sey, ‘Di Raitious Man go kom and una go gi-am to wiked pipol and dem go kill-am.’


Di same Jew pipol wey dey ponish us, na dem still kill awa Oga God Jesus Christ and di profets. Dem dey wiked to evribody and nor dey do wetin God wont.


And wen dem don tok finish, di beast wey kom out from di pit go follow dem fight kon win and kill dem.


Bikos dis pipol kill yor pipol and profets, so yu don give dem blood make dem drink, bikos na wetin good for dem bi dat!”


God pipol wey dem kill and doz wey prish about Christ, I si di woman wen e dey drink dia blood and di blood dey shark am like wine. I sopraiz well-well wen I si di woman.


bikos en judgement dey true and korrect. E don ponish dat ashawo wey spoil di world with en sins, as e dey sleep with who e nor marry and God don revensh am for Christ savants wey e kill!”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ